Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 20:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Good pipol dey always do di rite tin and God dey bless dia shidren.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 20:7
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“I go keep my promise wey I make with yu and to yor shidren-shidren, di kovenant go always dey forever. I go bi yu and yor shidren God.


E get one man wey dem dey koll Job, e dey stay for Uz land and e dey do wetin God wont. E dey serve God with klean belle and e nor dey do bad tins.


En shidren-shidren go get pawa for dis world and God go bless di pipol wey dey obey am.


Na doz wey dey live good life and do wetin dey rite; pipol wey dey tok trut with pure heart.


My God, my hand klean and I trust Yu with all my heart, so make Yu show sey I dey innocent.


But I nor bi like dat; I dey live betta life. So, make Yu kom save and sorry for mi.


Dis pipol dey always happy to give and blessing dey follow dia shidren.


Good pipol dey leave propaty for dia grand-shidren, but na doz wey dey fear God dey take evritin wey wiked pipol die leave.


Doz wey dey do wetin dey good, dey fear God; but doz wey dey do wiked tins, nor dey fear am at-all.


Doz wey dey fear God, dey save and God dey guide dia shidren.


E betta make pesin dey poor and get good karata, dan make e bi fool wey nor get trut for mout.


Di pesin wey dey do and tok wetin dey rite; wey nor dey shit poor pipol, bikos e get pawa and wey nor dey take bribe, join doz wey kill pipol or join do bad tins,


Di only tin wey I go let dem do for dis life: na to always dey honor mi, bikos na for dem and dia shidren-shidren good.


Dem dey do wetin God like, dey follow all di tins wey God tok for en word.


Bikos dis promise na for una, all una pikin, pipol wey dey far place and all di pipol wey God go draw near ensef.”


Wi dey happy, bikos wi know sey di way wi dey live awa life for dis world and how wi dey bihave with una, dey show sey na God send us thru en pawa, nor bi human being own.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ