5 Betta advise for pesin heart bi like wota for inside deep well, but pesin wey get wisdom go draw am kom out.
As dem dey plan dia evil, dem go sey, “Na betta plan wi dey plan so o-o!” True-true, nobody fit si wetin dey inside human being heart or mind.
Word wey pesin tok fit give yu sense wey deep like sea and fresh like river wey dey flow.
Farmer wey lazy well-well to klear en farm for di rite time, nor go get anytin to harvest.
Some pipol dey tok how dem dey honbol and faithful, but e go hard to find pesin wey really bi like dat.
Na only pesin spirit know wetin dey di pesin mind and na only God Spirit know wetin dey God mind.