3 Na only foolish pesin dey start kworel; so di rite tin to do, na to run from am.
So Abram men and Lot men wey dey look afta dia animals kon bigin kworel. (For dat time, na Kanaan and Periz pipol dey stay for di land.)
Abram kon tell Lot, “Make mi and yu nor kworel and make awa men nor kworel too, bikos wi bi brodas.
King Jehoash ansa King Amazaya, “Lebanon bush send message to di cedar for Lebanon sey, ‘Make yu give yor dota to my son as en wife.’ Den one wiked animal for Lebanon kon skata di bush.
Pipol wey dey vex anyhow dey do foolish tins and pipol hate doz wey dey deceive odas.
Pipol wey get sense, dey kontrol demsef wen dem dey vex; but doz wey dey kwik vex, dey show as dem foolish rish.
E betta to dey patient dan to bi strong warrior. E betta make yu kontrol yorsef dan to kontrol di whole town.
To start kworel bi like wen yu leave wota make e dey rush; so e go good make yu stop am, before e go kause big wahala.
Wen foolish pesin start to argue, na trobol e dey put ensef.
If yu get sense, yu go fit kontrol yor tempa. E dey good make yu nor ansa if pesin offend yu.
Pesin wey dey karry body up and do wayo, nor dey kare about oda pipol.
Pesin wey go argue matter wey nor koncern am, bi like wen yu dey waka for road kon go hold dog for en ear.
Make una dey good to one anoda; dey sorry for pipol and dey forgive each oda, just as God forgive una thru Christ.
But if jealousy and sefishnes dey en mind, make e nor boast and lie against di trut.
Wetin dey make una kworel and fight? Nor bi di tins wey dey hongry una to do?