27 God lite dey enter human being spirit kon open all di plans wey dem get.
So Oga God take some san-san for groun take mold man kon breath life enter en nose, den di man kon dey breath.
But I don si am sey na God Almighty spirit dey enter and give human being wisdom.
Love wey nor dey fail and goodness dey protet di king and na dis love dey make en throne dey forever.
Korrect ponishment dey drive evil komot from pesin mind kon make en heart klean.
Di way dem dey bihave show sey wetin Moses rite for di law, dey dia heart and dia mind dey tell dem sey, “Dis tins dey rite and e go kondemn or free us from wetin wi do.”
Na only pesin spirit know wetin dey di pesin mind and na only God Spirit know wetin dey God mind.