Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 20:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

24 Na God dey direct pesin; so how pesin won use en own mind take know as en life go bi?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 20:24
10 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

How wi go take know doz wey dey fear God? Na doz wey God go show di rite road wey dem go follow.


My God, make Yu show mi di rite way kon point di road wey I go follow.


God dey lead doz wey dey fear am. E dey-dey happy with evritin wey koncern dia life.


Wise pipol know where dem dey go, but foolish pipol dey deceive demsef.


Even doh wi fit make awa own plans, na God get di final sey.


Pesin fit make en own plan, but na God dey direct anytin wey e go do.


My Oga God, wi know sey pipol nor fit kontrol dia own destini and dem nor get di pawa to know wetin go happen to dem.


Instead, yu dey against God wey get heaven and eart. Yu bring all di tins from di temple, den yu and yor men, plus yor wife and yor girl-friends kon use dem dey drink wine. Yu dey praiz di gods wey dem make with gold, silva, bronze, iron, wood and stone; gods wey nor even fit si, hear or undastand! But yu neva ever praiz God wey dey kontrol yor life and ways!


Bikos na inside am wi dey live, waka, get life and some of una wey dey rite poem tok sey, ‘Wisef na God pikin.’


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ