Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 20:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 Propaty wey pesin use wayo take kwik get for life, nor dey last.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 20:21
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Good pipol dey leave propaty for dia grand-shidren, but na doz wey dey fear God dey take evritin wey wiked pipol die leave.


If yu curse yor papa and mama, yor life go end like lantan wey kwensh for darkness.


Nor do bad to pesin wey do yu bad, but make yu trust God and E go save yu.


Di money wey yu use wayo take get go disappear, but dat go bi afta e don push yu put for deat hand.


As yu dey try to get money, make yu use yor sense, so dat life nor go taya yu,


Pesin wey dey tok trut, go live betta and happy life, but dem go ponish yu, if yu dey hurry to get money.


Pesin wey get long-trot dey always hurry to get money, sotey e nor dey know wen poverty dey kom meet am.


If yu get money from intrest wey yu dey kollect, bikos di pipol kon borrow from yu, one day, one pesin go kom kollect all yor propaty and e go sorry for poor pipol.


“But very soon, di pipol wey dem katch, go ponish who katch dem. Dem go sey, “ ‘Una take wetin nor bi una own and naw, una own don finish! But na how long dis kind tin go kontinue?’


Oga God sey, “Doz wey dey tif and lie, I go send dis curse go meet dem for dia house and di curse go stay and distroy dem finish.”


Una must honor mi with wetin una dey do, but if una nor gri listin to wetin I dey tok, I go curse una. I go bikos of wetin una do, curse evritin wey una get. True-true, I don already curse una, bikos una nor gri honor mi.


Pipol wey won get money by force, dey fall enter temptashon and dem dey get troat for yeye tins wey go distroy and put dem for wahala.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ