19 Pesin wey dey do aproko nor go fit keep sekret. So make yu run from pesin wey dey tok too mush.
I go distroy anybody wey dey plan bad for en neighbour and I nor go sorry for who dey deceive pipol or doz wey get pride.
Pesin wey dey judge anoda pesin, nor go fit keep sekret, but yu fit trust pesin wey dey tok trut.
Doz wey dey kontrol dia tongue go get long life, bikos anyhow word dey distroy tins.
Pipol wey dey kause wahala dey deceive dia friends enter trobol.
To do aproko, dey good well-well for mout wen yu dey tok am, bikos e dey sweet for body.
So my pikin, make yu fear God and honor di king. Make yu nor do anytin with pipol wey dey tok against dem,
Make una nor lie about anybody and if anybody dey pass thru problem for life; make una help am. Na mi bi God.
Bikos dis kind pipol nor dey serve awa Oga God Jesus Christ, but na dia belle dem dey kare for. With dia sweet and wayo mout, dem go praiz and deceive pipol wey nor wise.