12 Na God give us eyes to si tins and ear to hear word.
Make Yu open my eyes to si di wonderful tins wey dey yor law.
Una tink sey di Pesin wey make una ear nor dey hear word? Abi di Pesin wey make una eye nor dey si?
God ask am, “Na who give man mout or na who dey make pesin fit tok, hear or si? Nor bi mi wey bi God?
Wen wise pesin advise pesin wey ready to listin, wetin e tok, betta pass fine gold ring or necklace.
Wen dat day rish, deaf pipol go hear words wey dem read from book give dem and blind pipol go si even inside darkness.
yu go open dia eyes make dem for waka komot from darkness enter lite. Make dem komot from Satan hand, go meet God, so dat God go forgive dem dia sins and dem go follow di pipol wey God don make klean, bikos dem bilive am.’
If to sey di whole body na eye, wi nor for fit hear anytin and if to sey all di body na ear, wi nor for fit smell anytin.