Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 20:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Too mush drink dey make pesin tok and bihave anyhow and pesin wey dey drink too mush, nor get sense.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 20:1
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

David invite am kom chop and drink till evening. But Uriaya nor still go house dat nite, instead e sleep for en blanket for di palis guard-room.


kon tell en savants, “Make una look, wen Amnon don drink well-well, den if I give di orda, make una kill-am. Make una nor fear, but get mind, bikos I go take all di blame!”


Nor make friend with pipol wey dey drink wine too mush or chop well-well,


Lemuel, my pikin! E nor good make king dey drink wine and make rulers too, nor dey take strong drink.


Even di profets and di priests dey stagga bikos dem don drink well-well. Dem don drink plenty wine and e dey konfuse dem. Dem don drink sotey dem nor dey fit undastand di vishon wey God send kom or judge any kase well.


Una own don finish! Una wey dey wake up for early morning bigin drink. Una dey drink still evening until di drink katch una well-well.


Una own don finish! Pipol wey bi champion for where dem for dey drink ogogoro! Dem dey get heart well-well wons e rish to mix difren drinks!


Dem go sey, ‘Make wi buy some wine and drink as wi like! Tumoro go betta pass today and wi go get evritin wey wi wont!’ ”


God sey, “Bikos my pipol dey drink old and new wine, dem nor get sense again.


Wen di king dey do party, en and en ofisas dey drink well-well and dem go dey make plans with yeye pipol.


“Make yu and yor sons nor drink wine or strong drink wen una enter di tent, so dat una nor go die and dis na law wey yu and yor shidren-shidren must obey.


True-true, wine go disgrace proud and wiked pipol! Dia mout wide like grave and just as deat nor dey beleful, na so too nor-tin dey beleful dem. Bikos of dia long-trot, dem don gada nashons kon swallow many pipol.


tif; long-trot; drunkard; doz wey dey curse pipol and doz wey dey play wayo; non of dem go enter God kingdom.


bad belle; killi-killi; to dey drink anyhow and dey do oda tins like all dis ones. I dey warn una naw as I don warn una before sey, pipol wey dey do dis kind tins, nor go enter God kingdom!


Make una nor dey drink strong drink, bikos e go distroy una. But make una allow God Spirit fill una mind.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ