8 E dey protet pipol wey dey trit odas well kon guide doz wey dey respet am.
True-true, God dey guide en pipol for evritin wey dem dey do, but E go distroy doz wey nor dey follow en ways.
God dey protet all di pipol wey love am, but E dey distroy wiked pipol.
E dey make mi strong. E dey guide and take mi pass di rite road, so dat pipol go honor en name.
Bikos God like to dey judge well and E nor go ever leave doz wey dey fear am.
Dem don make God law dia own, so dem nor go ever sin.
Awa life dey en hand and E nor let us fall.
Una wey love God, make una hate bad tins! God dey protet pipol wey dey fear am kon save dem from wiked pipol pawa.
I dey follow korrect judgement and I always dey do wetin dey rite,
No lion go dey der and wild animals nor go pass dat place. Na di pipol wey God don save, go pass dat road.
Yes! God really love en pipol; all doz wey dey holy dey en hand. Dem waka as E dey waka kon do di tins wey E tish dem.
and en pawa dey protet am thru faith and wi dey wait for di salvashon wey go kom for di time wen di world go end.
Naw, make all glory bi God own, bikos E nor let una fall and E go bring una kom en present with betta joy wey nor get fault.
E dey wosh and guide di pipol wey E choose, but E dey make wiked pipol shut up for di dark place wey dem dey, bikos nobody fit win war with en own pawa.