3 Yes, make yu beg for wisdom and yu go get undastandin.
Make di Oga wey bi yor God give yu wisdom to take rule Israel, just as E tok.
I bi yor savant, so make Yu give mi sense, so dat I go undastand yor rules.
My God, make Yu listin to my kry; make Yu give mi betta sense thru yor word!
Make Yu make mi undastand and I go obey evritin wey Yu tok kon learn dem with all my heart.
Na Yu make and kreate mi. Naw, make Yu give mi di sense to follow yor kommand.
Listin to wetin dey wise and try make yu undastand am.
Find am well-well, just as yu go take look for silva or oda good tins.
Always dey remember God kommand for anytin wey yu dey do, den E go show yu di korrect way.
My pikin, make yu listin to wetin yor papa dey tish yu; put yor ear down and yu go undastand.
I love only doz wey love mi; anybody wey dey look for mi, go si mi.
Since una fit give una pikin good tins as una bad rish, wot of una Papa for Heaven wey go give di Holy Spirit to anybody wey ask am?”
But if anybody nid wisdom, make e ask God wey dey gi-am to evribody. E nor go sey, “No,” but E go give yu.