I still si sey, woman wey wont make man sleep with am, dey set trap for am and dis one dey wiked and bad pass deat. Pipol wey dey obey God, go fit eskape am, but doz wey dey sin, go enter di trap.
Thru-out di seven days wey dem do di party, di woman dey always kry for Samson. But for di sevent day, Samson kon tell am di ansa, bikos e dey always disturb am. Den di woman go tell di pipol.