8 Do good to yorsef kon learn evritin wey yu fit learn; den remember wetin yu learn and yu go prosper.
Dem dey tish yor savant well and doz wey dey obey dem, go get betta reward.
Listin to wetin dem tish yu and yu go dey susesful; make yu trust God, so dat blessing go follow yu.
Foolish pesin nor get time to spend en money to get wisdom, bikos e nor undastand wetin wisdom bi.
Anybody wey tok lie for wetin e nor know, nor go fit eskape ponishment and na di lie go kill-am.
yu go happy, if yu remember and use dem well.
Wisdom na tree wey dey give life and e dey make pipol wey kom meet am, happy.
So my pikin, whole di wisdom and undastandin wey yu get well and yu nor ever let dem live yu.
Dem go make yu live sweet and happy life. Dem go bi like betta shain for yor neck.
Nor ever let dis words leave yu, remember and protet dem with yor heart.
my papa go tell mi, “Make yu always remember wetin I tish yu. Do wetin I tok and yu go get long life.
If yu love wisdom, e go protet yu; if yu love am well-well, e go save yu.
I go give una new heart; di one wey go make una obey my kommand.
Anybody wey love en life for dis world, go luz am, but di pesin wey nor love en life for dis world, go get life wey nor dey end.
Anybody wey hear and do wetin I tok, love mi. Di pesin wey love mi, mi and my Papa go love am too and I go show am who I bi.”
God word sey: Anybody wey won enjoy good life, must kontrol en mout; make e nor dey tok bad-bad tins or lie.