7 Man wey nor get money, nor get value for en brodas hand, even en friends dey run from am. Aldo e dey beg dem, but dem nor dey ansa am.
Pipol wey I love and wey bi my friends, dey run from mi, bikos dem dey fear my diziz. Even my own family membas stand for far dey look mi.
Yet, my enemies still dey set trap to kill mi. Pipol wey hate mi dey plan to skata my life and na evriday dem dey plan against mi.
Yu don allow pipol wey I love and doz wey love mi, dey run from mi. So, na darkness bi my best friend naw.
Yu don porshu my friends kon fool mi for dia front and naw, I dey for trap wey I nor go fit run komot.
Money dey protet rish pipol, but poverty dey distroy poor pipol.
Poor pipol neighbours hate dem, but rish pipol get many friends.
Poor man dey honbol ensef as e dey tok, but rish pipol dey ansa and tok anyhow.
Rish pipol dey always get new friends, but poor man nor fit keep di small ones wey e get.
If yu nor gri listin to poor pipol kry, dem nor go hear yor own kry for help.
Make yu nor forget yor friends or yor papa friends, bikos if yu dey trobol, yu nor nid to ask yor relashon for help. Di neighbour wey dey near yu, fit help yu pass yor relashon wey dey far.
But una nor dey respet poor pipol! Nor bi rish pipol dey opress and drag una go kourt?