29 Just as dem dey beat foolish pesin, na so too dem go ponish doz wey dey karry body up.
So Elisha turn look dem kon curse dem with God name. Den two woman bear kom outside from di wood kon kill forty-two of di boys.
God go bless di pesin wey nor dey follow wiked pipol advise, dey waka with sinnas or sidan with aproko pipol!
Pipol wey nor get sense, na how long una won take bi fool? Na how long una won take wisdom do yeye? Una nor won learn at-all?
So, I go laf una wen una enter trobol kon take una do yeye wen wahala start.
If pesin get sense, e dey show wen e dey tok, but if yu dey foolish, na stik dem go take beat yu.
Pesin wey get sense dey take korreshon if dem korrect am wons, but foolish pesin go only take korreshon afta dem don beat am well-well.
Wen foolish pesin start to argue, na trobol e dey put ensef.
E dey eazy to whip horse and kontrol donkey, but e nor eazy to kontrol foolish pesin.
God nor get wetin E won do with proud pipol, but E dey favor pipol wey dey honbol.
Small time, e bigin follow am like melu wey dem won go kill and like animal wey waka fast enter trap
Na yu go gain if yu get wisdom, so even if yu rijet am, na yu go still sofa am.
So make una nor laf as I dey warn una, if not, e go hard una well-well to eskape. Bikos I hear wen God wey get pawa sey E go distroy di whole kountry.
Bikos pipol wey dey opress odas go vanish and all doz wey like to dey do bad tins, go die.
If di judge sey make dem flog di one wey dey wrong, di judge go kommand am make e liedan for en front make dem flog am.
Bikos na di pesin wey God love, na-im E dey korrect and E dey ponish all di shidren wey bi en own.”