28 If witness for kourt dey tok wetin e nor si, den di judge nor go fit judge well. Wiked pipol like to dey do evil tins.
Evry oda tin wey Omri do, dem rite am for Israel kings history book.
Make una arrange two jaguda make dem akuiz am sey, e curse God and di king. Den take am komot for di town kon stone am die.”
Leta, di two jaguda kon akuiz Nabot sey, e curse God and di king, so dem take am go outside di town kon stone am die.
how E won take bilive man wey dey drink bad and wiked tins like wota?
Yu don si any man wey bi like Job wey dey tok anyhow?
Wiked pipol dey sey, “God nor dey si us! E don klose en eye and E nor go even fit si wetin wi dey do!”
Dem dey prosper for evritin wey dem dey do. Dem nor dey si yor ponishment wey dey wait dem. Dem dey laf doz wey bi dia enemies.
Wise pipol dey hongry to learn, but foolish pipol dey enjoy wetin dem tink sey dem know.
Wiked pipol dey always look for how to wound odas; even wetin dem dey tok fit burn and kill pesin like fire.
My pikin, if yu stop to learn, yu go forget evritin wey dem tish yu.
Bikos dem dey make money from my pipol sin, dem kon dey kommit more sin.