Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 19:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 Wetin important pass na to dey loyal. E betta make yu dey poor, den to dey lie waka.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 19:22
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I know sey Yu dey test evribody heart and Yu dey like doz wey dey respet diasef. I put my body for groun kon use all my heart take give Yu all dis tins and I don si how all yor pipol dey happy as dem dey give Yu dia gifts.


But God tell am, ‘E dey good as yu get am for mind to build temple to take honor mi.


Pesin wey sell en friend bikos of money, na en shidren go sofa am.


But my friends, una don show sey una bi like wota wey dry bikos rain nor fall!


Human being bi like ordinary dirty wey breeze dey blow and pipol wey feel sey dem strong, nor get pawa at-all. If yu go measure dem for skale, all of dem togeda nor heavy rish air.


E betta make pesin dey poor and get good karata, dan make e bi fool wey nor get trut for mout.


Pipol fit plan difren-difren tins, but na wetin God tok, go happen.


Obey God and yu go get long life; yu go dey happy and dey save from trobol.


Bikos if e really dey una mind to do am, anytin wey una give akordin to wetin una get, God go asept am, but nor bi wetin una nor get.


Di trut dey give dem di mind sey dem get life wey nor dey end and na God wey nor fit lie promise dem dis life even before E kreate di world.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ