Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 19:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 Pipol fit plan difren-difren tins, but na wetin God tok, go happen.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 19:21
32 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Even doh una mind na to kill mi, but God let am bi like dat, make betta tins for happen, so dat many pipol go dey save as una dey si today so.


Absalom and Israel leaders kon sey, “Hushai advise betta pass Ahitofel own.” God don decide sey dem nor go follow Ahitofel good advise, so dat wahala go follow Absalom.


But Estha go meet di king and di king give orda make Haman use en own head karry di wiked plan wey e make. So dem kon hang Haman and en sons.


E neva shange and nobody fit oppoz or stop am from wetin E won do.


Aldo dem plan against Yu, dia wiked plan nor go work.


Dem dey sey, “Make una kom make wi kill evribody for Israel finish and nobody go remember dem again.”


God dey happy with good pipol, but E dey kondemn doz wey dey plan wiked tins.


Even doh wi fit make awa own plans, na God get di final sey.


Pesin fit make en own plan, but na God dey direct anytin wey e go do.


Wetin important pass na to dey loyal. E betta make yu dey poor, den to dey lie waka.


Evry king heart dey God hand; just as E dey show river how e go take flow, na so too E dey kontrol kings mind.


Yor wisdom, brain and undastandin nor mean anytin if God dey against yu.


But I still learn dis one too: God kreate evribody make dem dey good, but dem don dey do wiked tins as dem like.”


God wey dey lead heaven sojas swear sey, “Make una know sey na as I plan am, na so e go bi and as I tok am, na so e go happen too.


I know di end from di biginnin and na from wen I kreate di world I don dey tok tins before dem happen. I sey na as I plan am, na so e go bi and I go do am as I wont am.


Mi wey bi God go show una sign sey I go ponish una for dis place and as I promise sey I go distroy dis place, na so e go bi.


“Una gri sey una won bi like di oda kountries; like pipol for oda kountry wey dey woship three and mountin. But una plan nor go work.


Yu nor fit kompare God with anybody for dis world. E dey do wetin E like with di angels for heaven and pipol for dis world. Nobody fit shalenge or ask am, “Wetin Yu tink sey Yu dey do?”


All tins dey happen as God wont am and thru Christ, E choose us to bi en own pipol, bikos na so E plan am from di time wen E kreate di world,


Na-im bi di rock wey dey fall pipol, bikos dem nor fit jump am pass. As dem nor bilive God word, dem bigin fall, bikos na so E plan sey e go bi.


Some pipol don hide join una and God don mark dem for distroshon. So I won tell una about dis tins sey, dis pipol nor dey fear God. Dem don dey use God grace as eskuse to dey do bad-bad tins. Dis pipol nor gri asept Christ as dia Masta and Oga God.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ