Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 19:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 If yu dey listin to advise and dey ready to learn, yu go wise one day.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 19:20
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So, make yu follow doz wey dey honest and dey do good, bikos doz wey like peace go get betta future.


So make Yu tish us, so dat wi go know sey wi bi ordinary human being, den awa wisdom go dey grow more-more.


Make Yu satisfy us evry morning with yor love wey nor dey fail, so dat till wi die, wi go always dey sing with joy.


E rite dem so dat pipol go get wisdom, undastandin and good advise.


Dis words go tish una how to live betta life, to dey honest and to dey tok trut and korrect word.


My pikin, make yu listin wen yor papa dey korrect yu and follow wetin yor mama dey tish yu,


Foolish pipol dey always tink sey wetin dem dey do dey korrect, but wise pipol dey listin to odas.


To dey karry body up, dey kause wahala, but doz wey dey take advise, wise well-well.


If yu nor like korreshon, na yorsef yu dey do; but if yu listin to korreshon, yu go always dey undastand.


If pesin get hot tempa, make e ready for anytin wey go happen, bikos If yu take am komot from trobol wons, yu go still do am again.


My pikin, make yu listin to wetin yor papa dey tish yu; put yor ear down and yu go undastand.


Kommon sense and suksess na my own. Na mi get undastandin and pawa.


Make una listin to wetin I dey tish una kon get sense. Make una nor rijet dem.


So Jerusalem pipol, make dis one bi warnin to una, if not, I go forget una kon make una land empty and nobody go fit stay der.”


God sey, “I bin tink sey, ‘Una go really respet mi!’ Naw, make una do wetin I tok! If to sey una really gri do am, dem nor for skata una house with all dis ponishment.” But na only to sin una dey tink about.


Who go fit kount Jakob dust, dem too many to kount. Make I die as God pikin; make I die in peace as betta man.”


How I wish sey dem get sense and fit undastand dis tins or know wetin go happen to dem.


feed una for di wildaness with manna (food wey una grand-grand papa nor ever know), so dat E go honbol and test una, den make una betta pipol.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ