18 Train yor pikin well wen dem still dey yong to learn; if yu nor do like dat, yu dey help dem distroy dia life.
Doz wey nor dey korrect dia shidren, hate dem. But doz wey love dia shidren, dey always korrect dem with love.
If pesin get hot tempa, make e ready for anytin wey go happen, bikos If yu take am komot from trobol wons, yu go still do am again.
Shidren nor dey know sey di way dem dey bihave nor good, but betta korreshon go tish dem how to bihave well.
If yu dey vex anyhow and nor fit kontrol yorsef, yu bi like town wey nor get fence at-all and wey dey eazy for enemy to attack.
To dey beat and korrect shidren, good well-well, bikos if dem dey do anytin wey dem like, dem go make shame katch dia mama.
Korrect yor shidren and yu go dey proud of dem, bikos dem nor go make yu shame at-all.
If pesin get sturbon son wey nor dey listin to en papa and mama even doh dem ponish am,