If yu get money from intrest wey yu dey kollect, bikos di pipol kon borrow from yu, one day, one pesin go kom kollect all yor propaty and e go sorry for poor pipol.
Make una give pipol wey nor get and God go give una wetin really big, E go pak am well-well and di tins go ova full. God go pour all dis tins for una life. But na as una take give odas, na so God go take give una too.”
Wen una harvest una plant kon leave some for di farm, make una nor go back go gada dem. Make una leave doz ones for strenjas; doz wey nor get papa and mama and doz wey dia husband don die, den di Oga una God go bless una for all di work wey una dey do.
God nor dey support pipol anyhow. E go remember how una help en pipol before-before and how una still dey help dem naw. Una bi God pipol and E nor go forget di love wey una show en shidren.