16 Keep God kommandment and yu go get long life; but yu go die, if yu nor follow dem.
Na vexnashon dey kill who nor get sense and na jealousy dey kill fool.
doz wey dey faithful to en kovenant and dey obey en kommand!
Pipol wey nor dey listin to advise dey ask for trobol, but doz wey dey respet di law, go susid.
If yu nor like korreshon, na yorsef yu dey do; but if yu listin to korreshon, yu go always dey undastand.
Doz wey good nor dey travel pass bad road; so look where yu dey go, bikos e fit save or distroy yor life.
Pesin wey nor gri asept wisdom, go die kon go where dead body dey.
If yu nor won enter trobol, make yu tink before yu tok.
Trobol and wahala dey where wiked pipol dey waka pass, but wise pipol wey sabi guide dia soul, dey-dey far from dem.
Wen pipol nor follow God way, dem dey waka anyhow, but pipol wey dey obey God law, na happiness bi dia own!
My pikin, make yu nor forget wetin I tish yu and always remember wetin I sey make yu dey do.
So, since yu don hear evritin, dis na my last advise: “Make yu fear God and obey all en kommands, bikos na wetin man suppose do, bi dat.”
Di king nor go ponish pesin wey dey obey am and doz wey dey wise, go find di way and time to do wetin dey good.
But I kommand dem sey, ‘Make una obey mi and if una obey mi, I go bi una God and una go bi my pipol. Make una live una life as I tell una and evritin go betta for una.’
En deat na-im own fault, bikos e nor gri listin to di warnin. If to sey e listin, e for run go hide.
Wetin pesin go gain, if di whole world bi en own, but e luz en soul? Or wetin pesin go fit give take pay for en soul?
Jesus kon tell am, “Yor ansa korrect, make yu do dem and yu go get korrect life.”
Den Jesus sey, “Pipol wey hear God word and do wetin e tok, na dem God don bless!”
“If una love mi, una go do wetin I tok.
Weda dem sekonsaiz yu or not, nor mean anytin. Wetin dey important, na to obey God law.
and anytin wey wi ask from am, E go give us, bikos wi dey do wetin E wont and na dis tins dey make belle sweet am.
To love God, na to keep en kommandment and en kommandment nor dey hard.
God don bless doz wey wosh dia klot klean, so dem go get authority to chop from di tree wey dey give life and dem go fit pass di gate enter di town.