11 If yu get sense, yu go fit kontrol yor tempa. E dey good make yu nor ansa if pesin offend yu.
Amanah and Farpar for Damaskus nor betta pass all di rivers for Israel? Why e nor send mi go one of dem, so dat I go well?” So Naaman vex komot from der.
Pesin wey dey judge anoda pesin, nor go fit keep sekret, but yu fit trust pesin wey dey tok trut.
Foolish pipol dey kwik vex, but wise men nor dey tok even wen dem curse dem.
Pipol wey get sense, dey kontrol demsef wen dem dey vex; but doz wey dey kwik vex, dey show as dem foolish rish.
Pesin wey dey kwik vex, naim dey first kause fight; but kwayet pesin dey kwayet for evriwhere.
E betta to dey patient dan to bi strong warrior. E betta make yu kontrol yorsef dan to kontrol di whole town.
To start kworel bi like wen yu leave wota make e dey rush; so e go good make yu stop am, before e go kause big wahala.
Nor do bad to pesin wey do yu bad, but make yu trust God and E go save yu.
Na only foolish pesin dey start kworel; so di rite tin to do, na to run from am.
If yor enemy dey hongry, make yu gi-am food chop and if e dey thirsty, make yu gi-am wota drink,
Stupid pipol dey show dia vexnashon for publik, but pipol wey get sense, dey-dey patient and kontrol demsef.
Make una dey good to one anoda; dey sorry for pipol and dey forgive each oda, just as God forgive una thru Christ.
My brodas and sistas, make una undastand dis tins: Make una dey listin well-well and nor dey kwik tok or vex.