6 Wen foolish pesin start to argue, na trobol e dey put ensef.
Foolish pipol dey kwik vex, but wise men nor dey tok even wen dem curse dem.
To dey karry body up, dey kause wahala, but doz wey dey take advise, wise well-well.
Wise pipol get sense and dem dey avoid wahala; but foolish pipol dey waka enter trobol.
Foolish words go make dem flog pesin, but wise pesin words, go save en life.
To start kworel bi like wen yu leave wota make e dey rush; so e go good make yu stop am, before e go kause big wahala.
If pesin get hot tempa, make e ready for anytin wey go happen, bikos If yu take am komot from trobol wons, yu go still do am again.
Just as dem dey beat foolish pesin, na so too dem go ponish doz wey dey karry body up.
Na only foolish pesin dey start kworel; so di rite tin to do, na to run from am.
If una porshu proud pipol komot from where una dey, kworel, wahala and bad words, nor go dey again.
E betta make yu stay on-top house, dan to stay with wife wey dey komplain well-well.
Even doh san and stone dey heavy, e nor still heavy rish di wahala wey foolish pesin dey kause.
Wen wise pesin take foolish pesin go kourt, di foolish pesin go only dey shaut and tok anyhow, but e nor go dey happy.