Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 18:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 E nor good to favor who do bad, bikos good pipol nor go get korrect judgement.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 18:5
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E nor dey support rulers or rish pipol against poor pipol, bikos na-im kreate all of dem.


sey, “Na how long una go dey judge like dis kon dey favor wiked pipol?


“Make una nor follow pipol do wiked tins; for inside yard, make una nor tok wetin una eye nor si, bikos plenty pipol dey tok am to take win dia kase


and make una nor lie against poor pesin for kourt.


“Make una nor give bad judgement to poor pesin for kourt.


God nor like pipol wey dey defend wiked pipol and kondemn doz wey dey innocent.


E nor good make dem flog innocent pesin and e dey bad to ponish who dey do good.


Wise pipol still tok dis tins too: E bad well-well if judge nor dey judge well for kourt.


To dey judge anyhow nor good, but some judge dey lie for kourt, bikos of di small bribe wey dem won kollect.


Bikos wen dem drink, dem fit forget di laws kon dey opress poor pipol.


Dem dey free pipol wey dey guilty kon opress doz wey dey innocent, bikos dem don take bribe.


Betta judgement dey far from us and good tins nor fit kom near us. Trut nor dey for where pipol gada and nobody dey good.


“ ‘Make una dey honest and pure wen ever una dey judge any matter. And make una nor dey trit poor pipol matter anyhow kon dey show good face to pipol wey get money.


Una wey bi leaders for Israel, make una listin to mi! Una hate to judge well and dey shange evritin wey dey rite.


Dia hand dey only like to do bad tins! Doz wey bi ofisas and judge, na only bribe dem wont. Doz wey get pawa, dey use am get wetin dem wont.


So dem kon send dia disciples, with some pipol wey dey support Herod, go meet Jesus sey, “Tisha, wi know sey yu dey tok trut well-well and yu dey tish wetin God wont. Yu nor dey favor anybody, bikos yu nor dey play wayo.


Make una nor judge anyhow or judge wetin una nor know. Make di judge dem nor take bribe from pipol, bikos bribe dey blind wise pesin eye kon spoil betta pipol mind.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ