Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 18:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 If men wey get pawa dey tok against each oda for kourt, to trow dice fit solve di matter.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 18:18
10 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Just like di leaders for Aaron family, dem divide dia work give dem with dice wey dem trow without sey dem use age or rank. King David, Zadok, Ahimelek, di priests and di leaders for Levi tribe dey der and dem do evritin for dia front.


Na so too, dem still give all Merari family twelf towns for Reuben, Gad, and Zebulun aria.


Di pipol leaders kon dey stay for di holy town for Jerusalem and if dem divide di pipol for Judah and Benjamin town into ten, na one part dey stay der, while di rest dey stay where dem dey before.


Wi dey plan as wi wont make tins bi, but na only God dey choose wetin go happen.


Di first pesin to tok for kourt dey always dey rite, until di oda pesin ask am kweshon.


To make peace with yor broda wey yu offend, hard pass to break enter town wey dem guide well-well and kworel, dey separate friends like gate wey dem lock with key.


Di land wey dem give di nine and half tribe, na dice dem trow take divide am, just as God tell Moses.


Den Saul sey, “My Oga wey bi Israel God! Wetin make Yu neva ansa mi today? Ansa mi with di holy stone. If na mi or my pikin kause dis sin, den make Yu ansa by Urim; but if na yor pipol kause am, make Yu ansa by Tummim.” Den God pick Saul and en pikin thru dice wey dem trow and Israel pipol kon dey save.


Den Saul kon sey, “Make una trow di dice for mi and my pikin.” Wen dem trow am, e kon katch Jonatan.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ