17 Di first pesin to tok for kourt dey always dey rite, until di oda pesin ask am kweshon.
As di oga hear di word wey en wife tell am sey, “Dis na how yor savant trit mi,” e kon dey vex for Josef.
Make yu dey listin well before yu ansa, If not, e go bi like sey yu bi stupid pesin wey nor get respet.
If yu won go meet important pesin, den karry gift follow body and e go dey eazy for yu to tok to am.
If men wey get pawa dey tok against each oda for kourt, to trow dice fit solve di matter.