15 Wise pesin dey always look for knowledge and en mind dey find wisdom.
So, make Yu give mi wisdom to rule yor pipol with good mind and to know wetin dey good or bad. If not, how I go take rule dis yor many pipol?”
But make yu let doz wey get sense before dem die, tish yu; make yu listin to wetin dem dey tok:
Make doz wey get sense listin to dis words kon wise more and make e guide doz wey get undastandin,
Wise pipol dey kollect all di wisdom wey dem fit get, but wen yu hear foolish pipol dey tok, yu go know sey trobol nor dey far from dem.
Wise pipol dey hongry to learn, but foolish pipol dey enjoy wetin dem tink sey dem know.
If yu listin well wen pipol dey korrect yu, yu go dey wise and get sense.
Make yu do anytin to get wisdom, trut, undastand and good sense and if yu get dem, make yu nor sell dem, bikos dem go help yu well-well.
Ask for wisdom and undastandin! Nor forget or abandon wetin I tok.
Na wisdom bi di best tin to get. If yu go get any oda tin, make e bi undastandin.
Anytin yu tell wise pesin go make am wise more-more. Anytin yu tell raitious pipol go give dem undastandin.
Mary, wey bi Marta sista, sidan near Jesus leg dey listin to wetin e dey tish.
I pray make God, awa Oga God Jesus Christ Papa wey get glory, give una spiritual wisdom and revelashon, wey go make una know am well-well.
But if anybody nid wisdom, make e ask God wey dey gi-am to evribody. E nor go sey, “No,” but E go give yu.