Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 17:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 Some pipol tink sey bribe dey work like majik; dem bilive sey e fit do anytin wey dem wont.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 17:8
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di present na two hundred woman goat, twenty man goat, two hundred iyu, twenty ram,


So e send di gifts go for front, while e kon sleep for en kamp dat nite.


Den dia papa Israel tell dem, “If na so e go bi, den make una do dis tin for mi: Make una karry some among di best tins wey wi get put for una bags kon give di man as gift; small balm, honey, spices and myrrh, pistachio and almond.


E kom down from heaven kon save mi, den E drag mi kom out from deep wota.


Di sun dey kom out from one end for di heavens till e rish di oda end and nor-tin fit hide from en heat.


My God, make Yu raiz-up with all yor pawa and wi go praiz and sing songs to take celebrate evritin wey Yu don do.


God vois get pawa well-well; en vois get glory.


“Make una nor take bribe, bikos bribe dey blind pesin eye and spoil good pipol.


Wiked judge dey take bribe for sekret and bikos of dat, dem nor go give korrect judgement.


If yu won go meet important pesin, den karry gift follow body and e go dey eazy for yu to tok to am.


If pesin dey vex for yu; gift wey yu gi-am for sekret go kool en tempa.


True-true, opreshon fit turn wise man to fool, just as bribe dey korrupt di mind.


Una leaders don rijet mi and na tif bi dia friends; dem dey always kollect bribe from pipol. If pipol wey nor get papa and mama and doz wey dia husband don die bring dia kase kom meet una, una nor dey defend or listin to dem.


Una sin and all di bad-bad tins wey una do, I know as dem bad rish. Una ponish good pipol; dey take bribe and nor allow poor pipol get korrect judgement for kourt.


Dia hand dey only like to do bad tins! Doz wey bi ofisas and judge, na only bribe dem wont. Doz wey get pawa, dey use am get wetin dem wont.


Make una nor judge anyhow or judge wetin una nor know. Make di judge dem nor take bribe from pipol, bikos bribe dey blind wise pesin eye kon spoil betta pipol mind.


Den David kollect di gifts kon tell Abigail, “Make yu go back to yor house in peace. Bilive sey I don hear wetin yu tok and nor-tin go happen to una.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ