But my Oga, na Yu choose mi to serve yor pipol and dat na wetin I dey do. Yu know evritin wey I tok and I neva for wons ask Yu make Yu finish with dem.
Tell dem sey make dem listin to wetin mi God wey get pawa dey tok: Una dey dance wen dem kill my pipol, distroy my temple and karry my pipol go Babilon as prisonas.
Just as una swallow my pipol for my holy mountin, na so too una and di oda nashons go swallow di ponishment wey I go give una. Una go drink kon stagga until una disappear komot from dis eart.