28 Pipol go tink sey foolish pesin get sense wen e kwayet and wen e nor tok, e go bi like pesin wey wise.
If to sey yu just kwayet, dat for bi wisdom for yu.
Make I dey wait wen dem nor get anytin to tok? Dem just stand for der, bikos dem nor get anytin to tok again.
Wen wise pipol tok, pipol dey undastand well, but na only yeye words dey kom out from foolish pipol mout.
Pipol wey nor kare about odas, dey tink only about demsef; so dem nor go gri take korreshon from oda pipol.
bikos dem go just dey tok anyhow waka. So, nobody really know wetin go happen naw or di ones wey go happen for future.
and even wen foolish pesin dey waka for road, e dey know and show evribody sey e bi fool!
Too mush tinkin dey kause bad dream and di more yu tok, di more yu go dey tok like fool.