25 Foolish shidren dey kause pain for dia papa and dia mama go dey regret.
Dem kon tell Joab sey David dey kry and mourn for Absalom.
Dis na di wise words wey Solomon tok: Shidren wey wise dey make dia papa proud, but fools dey kause pain for dia mama.
Shidren wey get sense dey always bring joy to dia papa; but foolish shidren nor dey respet dia mama.
Papa and mama wey dia shidren dey do like fool, na only sadnes and pain dem dey feel.
Foolish shidren fit distroy dia papa and mama, na so too, wife wey dey komplain well-well, bi like rain wey dey drop small-small.
Make yu do wetin go make yor papa and mama happy for yu, so dat yor mama nor go regret sey e born yu.
To dey beat and korrect shidren, good well-well, bikos if dem dey do anytin wey dem like, dem go make shame katch dia mama.