20 Make doz wey dey tink and tok bad-bad tins nor espect any good tin escept trobol.
To pipol wey get pure heart, Yu dey show dem as Yu pure rish, but to wiked pipol, Yu nor dey sorry for dem at-all.
Pesin wey dey hide di trut dey kause trobol, but pesin wey dey tok am for publik, dey work for peace.
Wise pipol dey kollect all di wisdom wey dem fit get, but wen yu hear foolish pipol dey tok, yu go know sey trobol nor dey far from dem.
Raitious pipol dey tok with sense, but anybody wey dey tok bad tins, go die.
bikos wiked pesin nor get betta future and dem nor dey hope for anytin again.
bikos God hate pipol wey dey do evil, but E dey draw raitious pipol near body.
If to sey una dey fear God, den una go hate bad tins. I hate pride, pipol wey dey tok anyhow, bad-bad tins and lie-lie words.
Wise pesin word dey favor am, but fool own, dey distroy am,