For dat time, Adonijah wey Haggit born for David kon dey boast dey sey, “Na mi go bi king!” So e buy plenty horse with pipol wey go dey drive dem and with fifty men wey dey escort am.
Bikos I dey fear sey wen I kom, I nor go like wetin I go si and una nor go like as I go tok. I dey fear sey una go dey kworel, dey jealous each oda; dey vex; dey tink of only unasef; dey tok bad about each oda; dey do aproko; dey karry body up and dey bihave anyhow.