Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 17:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 Betta friend dey always show en love and yor relashon go always dey with yu wen yu dey face wahala.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 17:17
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Jonatan my broda, si as I dey kry for yu! I love yu with all my heart, bikos di love wey yu get for mi, deep pass di one wey dem dey love woman.


But Ittai ansa, “My king, I use God name take swear sey I go follow yu go anywhere wey yu dey go, even if I go die put.”


If yu keep kwayet for dis time, God go send help kon from heaven and wi go dey save, but yu go die and yor papa family go end. Yu know weda na bikos of dis tin, na-im make yu bi kween!”


Wiked pipol dey do aproko waka; dem dey kause trobol and break friendship.


Friendship if put yu for trobol, but some friends go dey klose to yu pass yor own broda.


Foolish shidren fit distroy dia papa and mama, na so too, wife wey dey komplain well-well, bi like rain wey dey drop small-small.


Man wey nor get money, nor get value for en brodas hand, even en friends dey run from am. Aldo e dey beg dem, but dem nor dey ansa am.


True-true, Jesus make pipol dey holy, so en and di pipol wey e make holy, na God kreate dem. Na dis make am nor dey shame to koll dem en brodas and sistas.


But Rut ansa, “Nor force mi sey make I leave yu! Anywhere wey yu go, na der I go-go. Anywhere wey yu won stay, na der I go stay. Yor pipol go bi my pipol and yor God go bi my God.


Jonatan kon make kovenant with David, bikos e love am as e love en own life.


So e kon tell David, “My papa dey try to kill yu. So make yu take kare as yu dey waka for morning and find somewhere go hide and make yu stay der alone.


I go-go meet my papa for di field where yu dey kon ask about yu. Wen e tell mi di problem, I go kom tell yu.”


Jonatan still swear again with David, bikos e love am. Jonatan love David as e love en own life.


Den Saul pikin Jonatan go meet David for Horesh kon tell am, “God go always guide yu.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ