14 To start kworel bi like wen yu leave wota make e dey rush; so e go good make yu stop am, before e go kause big wahala.
Den Israel pipol go meet di king kon sey, “Awa king, wetin make awa brodas for Judah hide escort yu, yor family and yor men cross Jordan River?”
Abijah with en sojas win dem well-well, dem kill 500,000 strong Israel sojas.
King Pekah for Israel wey Remalaya born, kill 120,000 sojas for Judah, bikos dem turn from dia grand-grand papa God.
To dey karry body up, dey kause wahala, but doz wey dey take advise, wise well-well.
Pipol wey get sense, dey kontrol demsef wen dem dey vex; but doz wey dey kwik vex, dey show as dem foolish rish.
Good ansa dey end vexnashon, but yeye words dey kause kworel between pipol.
E betta to dey patient dan to bi strong warrior. E betta make yu kontrol yorsef dan to kontrol di whole town.
Pesin wey like to dey kworel, like trobol and If yu always dey karry body up, den yu dey kause wahala for yorsef.
If yu get sense, yu go fit kontrol yor tempa. E dey good make yu nor ansa if pesin offend yu.
Na only foolish pesin dey start kworel; so di rite tin to do, na to run from am.
Nor kwik karry matter go kourt, bikos if anoda witness show sey na yu dey wrong, den, na wetin yu go do?
Pipol wey like wahala dey kause trobol, just as mashes and kerosine dey start fire.
Pesin wey get hot tempa dey kause kworel and pesin wey dey kwik vex, dey sin well-well.
and make una try to live for peace with evribody.
Make una dey do well, so dat una go live kwayet life; dey mind una own business and dey work with una hand as wi kommand una before.