Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 17:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Deat go kom meet wiked pipol wey dey always kause trobol.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 17:11
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

As e dey offa sakrifice, e send message go Gilo town go koll Ahitofel, wey bi one among doz wey dey advise David. Dia plan against di king strong well-well and doz wey dey follow Absalom kon dey plenty more.


Den ten of Joab sojas kon follow am kill Absalom.


Den Ahimaaz wey bi Zadok pikin kon tell Joab, “Make I run go tell David di good news sey God don save am from en enemies.”


E get one man for Gilgal wey dem dey koll Sheba, na Bikri bi en papa wey kom from Benjamin tribe. E blow trumpet take koll di pipol kon sey, “Make David get out! Wi nor go follow am again! Israel men, make wi dey go awa house!”


Den e go meet di town pipol with en plan, so dem kut Sheba head kon trow am go give Joab for di oda side for di wall. Joab blow en trumpet take tell en men sey make dem leave di town and dem kon go house go meet di king for Jerusalem.


So, Solomon ansa, “Make yu do as e tok. Kill and beri am, so dat dem nor go hold mi, yu or any oda David pikin for wetin Joab do wen e kill innocent pipol.


Den di king orda Benaya and e kill Shimei. So, Solomon kon dey kontrol evriwhere.


Pesin wey get sense dey take korreshon if dem korrect am wons, but foolish pesin go only take korreshon afta dem don beat am well-well.


E betta make wiked animal attack pesin, dan to listin to wetin foolish pesin dey tok.


So my pikin, make yu fear God and honor di king. Make yu nor do anytin with pipol wey dey tok against dem,


Dem ansa Jesus, “E go distroy doz evil pipol! Den e go hire di farm give oda farmers wey go gi-am wetin bi en own, wen harvest time rish.”


Di king vex well-well kon send en sojas make dem go kill di pipol wey kill en savants and make dem burn evritin for dia town.


But doz my enemy wey nor wont make I bi dia king, make una go bring and kill dem for my front!’ ”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ