So Esau kon hate Jakob, bikos of en blessing wey en papa give en broda. Esau kon tell ensef sey, “Di time to mourn for my papa don near, den I go kill my broda Jakob!”
Dem still take di dokument wey di king give dem kon gi-am to di govnors and ofisas wey dey West Eufrates aria and dem too kon dey support di pipol and God Temple.
God ansa, “I go diliver and save Jerusalem from evry attack even doh I allow dia enemies karry dem go, so dat dem go learn. But wen una enemies dey trobol, dem go run kom meet una sey make una help dem.
make E give una evritin wey una nid to do wetin E wont. Anytin wey good for en eye, make E do am inside us thru Jesus Christ. Make all glory bi Jesus Christ own forever and ever. Amen!