4 Evritin wey God kreate get en purpose; but na wahala, wiked pipol go get.
So God si evritin wey E kreate and dem good well-well! And dat evening and morning kon make am di sixt day.
Dem dey waka anyhow dey find food. Dem know sey di day wey God go distroy dem don near.
Di day wey God go vex ponish pipol, na di wiked ones E go sorry for.
Dis na di rizin why I neva kill yu. I just won show yu my pawa, so dat pipol go praiz my name for evriwhere for di eart.
God hate pipol wey dey karry body up; E nor go let dem eskape en ponishment.
God dey make evritin happen for di rite time. Yet nobody go fit really undastand all di tins wey E don do and E put kweshons for awa mind about wetin don happen before and wetin go still happen.
Na mi form dis pipol for mysef and dem go sing praiz mi!”
Dem bi my own pipol and I kreate dem, so dat dem go give mi glory.”
Bikos na God kreate evritin and na thru am evritin dey. Make praiz bi en own forever and ever! Amen.
But God won show sey E dey vex, so E kon use en pawa against doz wey E won ponish.
Na-im bi di rock wey dey fall pipol, bikos dem nor fit jump am pass. As dem nor bilive God word, dem bigin fall, bikos na so E plan sey e go bi.
and dis tishas go deceive una with dia wayo. God don kondemn dem tey-tey and Christ wey go distroy dem, nor dey sleep.
If God do all dis tins, den E know how to save en pipol from trobol kon tie wiked pipol keep, so dat E go ponish dem wen E go judge di world.
“Awa Oga and God! Yu dey worthy to receive glory, honor and pawa, bikos na yu kreate evritin as yu wont.”