Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 16:33 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

33 Wi dey plan as wi wont make tins bi, but na only God dey choose wetin go happen.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 16:33
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di pipol leaders kon dey stay for di holy town for Jerusalem and if dem divide di pipol for Judah and Benjamin town into ten, na one part dey stay der, while di rest dey stay where dem dey before.


E betta to dey patient dan to bi strong warrior. E betta make yu kontrol yorsef dan to kontrol di whole town.


If men wey get pawa dey tok against each oda for kourt, to trow dice fit solve di matter.


Evribody wont make king favor dem, but na only God dey give korrect judgement.


Babilon king go stand near di sign post for where di road for start. E go shake di arrow, ask en juju kweshon kon shake di animal liver wey dem sakrifice, so dat e go know where e dey go.


E go trow dice kon mark one goat sey, ‘Dis one go bi ofrin to God’ and di oda goat go karry di pipol sin go Azazel wildaness.


So di sailors kon sey, “Make wi trow dice take know di pesin wey dey kause dis wahala for us.” So dem trow dice and e kon show sey na Jonah dey kause am.


Naim dem kon vote to choose between di two men and di pesin wey dem choose, na Matias.


For der, Joshua kon trow dice for God present kon divide di land among Israel pipol just as e suppose to bi.


Den I go divide am into seven. Judah go stay for di sout-side and Josef family go dey nort.


“ ‘Wen day break, una must kom akordin to tribe. Di tribe wen God go choose go kom akordin to village. Di village wey God go choose go kom akordin to family. Di family wey God go choose must kom man by man.


Dis na wetin wi go do Gibeah pipol; wi go pick pipol wey go attack dem.


But today, una don rijet di God wey save una from all una trobols and wahala. Una don sey, “No! Choose king wey go rule us.” Naw make una stand for God present akordin to una tribe and family.’ ”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ