Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 16:23 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

23 Wise pesin dey tink well before e dey tok; so wetin e tok dey give pipol hope.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 16:23
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“Pesin wey get sense dey tok anyhow? Abi di east wind fit make am beleful?


But make yu let doz wey get sense before dem die, tish yu; make yu listin to wetin dem dey tok:


Na betta words full my heart for di king and I go use my vois praiz am, just as dem dey use biro rite for book.


Doz wey dey fear God, dey tink before dem tok; but na only evil words full wiked pipol mout.


Na good advise dey kom out from wise pipol mout; but foolish pipol heart nor get anytin to give.


Yu go no pesin wey wise and dey mature bikos of di undastandin wey e get. As en word sweet rish, na so too e dey give pipol hope.


Wisdom bi like wota wey dey give life to wise pipol, but na waste of time to go tish foolish pesin.


Den yu go know how to bihave well and di way yu go dey tok, go show sey yu get wisdom.


Make Christ word stay inside una and make una dey tish each oda with wisdom wey go make una heart strong. Make una dey sing psalms, hymns and spiritual song and dey do all dis tins to really tank God from una heart.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ