God wey get pawa don tish mi wetin I go tok, so dat I go fit make pipol wey dey weak, strong. Evry morning, I dey-dey happy to hear wetin God dey tish mi.
Make doz wey dey wise, undastand dis tins. Make doz wey get sense, listin well-well. God ways dey true and e dey rite too and pipol wey dey raitious, dey follow am as dem dey live dia life. But doz wey dey sin, go stagga fall.
For dat time, Jesus kon sey, “I praiz yu Papa, Oga God wey get heaven and eart, bikos yu hide dis tins from pipol wey get sense and doz wey know book well-well, but yu show dem to small shidren.
I dey happy, bikos evribody don know how una dey obey God. But I wont make una dey wise wen e rish matter wey koncern wetin dey good or bad. Make una nor do any bad tin.