Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 16:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 Listin to wetin dem tish yu and yu go dey susesful; make yu trust God, so dat blessing go follow yu.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 16:20
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem ask and pray to God make E help dem and God ansa dia prayers kon make dem win di war.


Pipol wey trust God dey sikure like Mount Zion; nobody go fit bend dem and dem go dey forever.


But pipol wey Israel God bi dia helpa and hope, dey inside di Oga God and na joy dey follow dem.


Make una dey respet God well-well or E go fit vex kon distroy una at wons, bikos of di way una dey bihave. But na blessing dey follow doz wey si am as dia Oga God!


Plenty trobol dey kom meet wiked pipol, but di love wey nor dey fail, dey kover doz wey trust God.


Make yu kom try God, den yu go si sey God dey good: Make yu si as God bless di pipol wey bilive am!


Pipol wey nor dey listin to advise dey ask for trobol, but doz wey dey respet di law, go susid.


Dem dey respet pesin wey get sense, but sturbon pipol go distroy demsef.


Savant wey dey bihave well go get pawa for di house pass en oga yuzles pikin and di savant go get share for di oga propaty.


Do good to yorsef kon learn evritin wey yu fit learn; den remember wetin yu learn and yu go prosper.


Doz wey find mi, go get life and God go favor dem.


Bikos of dis, God dey ready to pity for en pipol; E sidan for en throne and E dey ready to forgive una. True-true, God dey good and evribody wey get faith and dey wait am, go happy well-well.


Nebukadnezzar kon sey, “I praiz Shadrak, Meshak and Abednego God, bikos na-im send en angel kom diliver en savants wey trust am. Dem nor gri obey di king kommand! Instead make dem bow woship my god, dem risk dia life kon sey, ‘Na only awa God wi go woship.’


Di king kon dey happy, so e orda make dem bring Daniel kom out from di pit. Dem bring Daniel out from di pit and e nor get sore for body or any mark, bikos e bilive di God wey e dey serve.


“Si! I dey send una go like sheep for where plenty wiked animals dey, so make una dey wise like snake and gentol like dove.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ