15 Wen di king favor pesin, e dey give life; e bi like kloud wey dey bring rain for en sizin.
Yor blessing bi like klot for en body and Yu gi-am joy for yor present.
Bikos en vexnashon nor dey tey, but en favor dey last forever! Even doh I kry for nite, I know sey joy go kom for morning.
Many pipol dey sey, “Who go fit show us wetin dey good?” So my God, make Yu smile for us.
Wen di king dey rule, e go bi like wen rain fall on-top grass wey dem kut; e go bi like rain wey dey wota di groun.
Wise pesin go try make belle dey always sweet di king, bikos if di king vex, somebody fit die put.
Wen king vex, e bi like lion wey dey shaut, but if e favor yu, e bi like rain wey dey fall.
Evribody wont make king favor dem, but na only God dey give korrect judgement.
So make wi serve God. As far day dey break and rain dey fall for di eart, E go kom save us.
Make una ask God for rain wen rainin sizin rish, bikos na God dey give rain wey dey make evritin wey pipol plant, grow.
“True-true, yu don show mi di way wey dey give life and yu go make mi happy well-well wen I dey for where yu dey.” ’