14 Wise pesin go try make belle dey always sweet di king, bikos if di king vex, somebody fit die put.
Fero wey bi king, vex well-well for en two ofisas
Di king vex kon stand up go di gardin, den Haman kon go knee down for di kween front dey beg am, bikos e know sey di king go ponish am.
Pesin wey dey kwik vex, naim dey first kause fight; but kwayet pesin dey kwayet for evriwhere.
Kings dey always won hear di trut and e go favor doz wey dey tok am.
Wen di king favor pesin, e dey give life; e bi like kloud wey dey bring rain for en sizin.
Deat go kom meet wiked pipol wey dey always kause trobol.
Wen king vex, e bi like lion wey dey shaut, but if e favor yu, e bi like rain wey dey fall.
Wen king vex, e bi like lion wey dey shaut; to make am vex, mean sey yu won kill yorsef.
Evribody wont make king favor dem, but na only God dey give korrect judgement.
Pipol wey nor get respet for odas, go fit kause konfushon for di whole town, but wise pipol dey keep tins to demsef.
If yor oga dey vex for yu, make yu nor vex stop di work wey yu dey do, bikos gentol spirit dey korrect big mistake.
Den Daniel go tell di king sey make e gi-am time and e go tell di king di dream and en meaning.
So di king send di soja wey dey kill criminals, make e go bring John head kom. So di man go inside di prison, go kut John head komot.
Herod kon dey vex well-well for Tyre and Sidon pipol. So dem gada go si am. But dem kon first beg Blastus wey bi di king offisa, make e help dem beg am, bikos na di king kountry dey supply food give dia kountry.
Wi dey ripresent Christ, so dat God go tok to una, thru us. Wi dey beg una bikos of Christ sey, “Make una shange kon bi God friend!”