13 Kings dey always won hear di trut and e go favor doz wey dey tok am.
Just as king dey happy for en wise savant, na so too e dey vex for doz wey disgrace am.
Make kings nor like wiked tins, bikos na korrect judgement dey make govment strong.
Wise pesin go try make belle dey always sweet di king, bikos if di king vex, somebody fit die put.
Pesin wey get klean heart and always dey tok well, di king go always bi en friend.