1 Even doh wi fit make awa own plans, na God get di final sey.
“Make yu go tell David wey bi my savant sey, ‘Nor bi yu go build temple for mi wey I go stay.
So wen dem si King Jehoshafat, all of dem tink sey na Israel king bi dat, so dem bigin attack am. But King Jehoshafat shaut and God help am.
Ezra kon sey, Make wi praiz di Oga, wey bi awa grand-grand papa dem God! Na-im make di king honor God Temple for Jerusalem like dis.
Make Yu listin to di prayers wey mi and yor savants wey dey honor Yu, dey pray. Make Yu help mi today, so dat di king go sorry for mi.” For dat time, na mi dey serve di king wine.
My plans don fail; my days go soon end and I nor get hope again.
Oga God, na Yu bi di hope wey poor pipol get. True-true, Yu go hear dia kry kon konfort dem.
Instead of to dey love money, make Yu let mi dey worry to know yor laws!
Den yu go tell am wetin e go tok. As for mi, I go tok thru una and I go tish two of una wetin to do.
To fear God, dey bring wisdom and to honbol yorsef, dey bring honor.
Pesin fit make en own plan, but na God dey direct anytin wey e go do.
Pipol fit plan difren-difren tins, but na wetin God tok, go happen.
Na God dey direct pesin; so how pesin won use en own mind take know as en life go bi?
Evry king heart dey God hand; just as E dey show river how e go take flow, na so too E dey kontrol kings mind.
My Oga God, wi know sey pipol nor fit kontrol dia own destini and dem nor get di pawa to know wetin go happen to dem.
Wi tank God wey give Titus di kind mind wey I get to help una.
bikos na God dey work inside una and una go fit do good tins kon get di pawa wey go make una happy.