Israel pipol, wetin make una still wont make dem beat una? Una wont make dem ponish una pass dis ones? Sore don already full una head and una body don rotin finish.
Dia face dey show sey dem dey guilty. Just like di pipol for Sodom, na so too dem dey boast about dia sin. E bad well-well for dem, bikos dem dey distroy demsef.
My God, shebi na trut Yu wont? But even wen Yu ponish dis pipol, dem still nor gri shange and wen Yu nearly distroy dem, dem nor gri take korreshon. Dia heart strong like rock and dem nor won turn from sin kom meet Yu make Yu for forgive dem.