Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 15:31 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

31 If yu listin well wen pipol dey korrect yu, yu go dey wise and get sense.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 15:31
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

How I wish una go gri listin, den I for give una good advise kon share my wisdom with una.


If yu vex sey pipol dey korrect yu, na poverty and disgrace go end yor life; but dem go honor yu, if yu asept korreshon.


Follow who get sense waka, so dat yu go get sense too; but if yu waka with foolish pipol, na trobol go follow yu.


Happiness dey bring joy to pesin heart and good news dey make pesin happy.


If yu nor like korreshon, na yorsef yu dey do; but if yu listin to korreshon, yu go always dey undastand.


Na only fool nor dey listin to en mama and papa word; but anybody wey dey take korreshon, go get sense.


Wise pesin dey always look for knowledge and en mind dey find wisdom.


If yu dey listin to advise and dey ready to learn, yu go wise one day.


Wen wise pesin advise pesin wey ready to listin, wetin e tok, betta pass fine gold ring or necklace.


E betta make wise pesin korrect yu dan make fool praiz yu.


My pipol, make una open una ear as una dey kom meet mi; make una kom meet mi and una go get life! I go give una kovenant wey go last forever kon give una di blessings wey I promise David.


Na from us dis pipol from komot, but dem nor really dey God family before, bikos if to sey dem dey, dem for stay with us. But dem live us, so dat evribody go know sey dem nor bi awa own.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ