Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 15:30 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

30 Happiness dey bring joy to pesin heart and good news dey make pesin happy.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 15:30
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“But naw, for dis short time, awa Oga God, Yu don trit us well kon stop some of us to bi slave and wi dey live for peace for dis Holy Place. Yu don remove us from slave work kon give us new life.


Pipol wey dey woship Yu, dey always dey happy; dem go waka for di lite wey dey yor present, bikos Yu don favor dem.


If pesin dey worry, e go make am sick, but betta word go make yor body strong again.


Doz wey dey fear God, na lite and joy full dia body, but wiked pipol lite go soon kwensh.


God dey far from wiked pipol, but E dey hear raitious pipol prayer.


If yu listin well wen pipol dey korrect yu, yu go dey wise and get sense.


Happiness dey give yu good life, but sadnes dey make pesin die small-small.


To hear good news from land wey far, bi like wen pesin pour kold wota or drink for en body.


If yu do like dis, yor body go dey okay and yor bones go strong well-well.


Lite sweet well-well and e dey good to si anoda new day.


Den I go always guide and satisfy una with good tins. I go make una dey strong and well. Una go bi like gardin wey get plenty wota and like wota wey nor go ever dry.


Di town nor nid sun or moon to shine, bikos God glory dey shine put and na di Lamb bi en lite.


Nite nor go dey again and dem nor nid lantan or sun lite, bikos God go bi dia lite and dem go rule forever and ever with am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ